The about our party cannot be hidden...We are making phenomenal progress

Five important things to know about Arthur Eze

Prince Arthur Eze net worth 2020

One recent study show say oga Arthur Eze net worth na $5.7 billion (₦2,240,134,000,000.00 Nigerian Naira) – dat na di total review of money wey dis man get as 2020.

Im dey worth 5.7 Billion US Dollars according to one report wey Viral Networth publish for November, 2019.

Wetin be Arthur Eze background?

Dem born am on 27th of November 1948 for Ukpo village, Dunukofia Local Government Anambra State, Nigeria.

Plenti pipo sabi dey call am ‘Prince Arthur Eze’ because im come from one royal family, and im elder brother na di traditional ruler (King) of Ukpo Village.

Arthur attend St. Augustin Secondary School for Nkwere, Imo State for 1970. Afta im secondary education, he go school for California State University, Long Beach, California to study mechanical and chemical engineering from 1974 to 1978.

Im dey married wit children. One of im children, Onyeka Eze, na di founder and president of Prince Osisioma Foundation.

Arthur Eze companies

Arthur Eze start Atlas Oranto Petroleum for 1991. Di company get about 22 oil and gas licenses for 12 places across Africa.

E get assets for Nigeria, Equatorial Guinea, Senegal, Sudan, Uganda and plenti oda Atlas Oranto blocks. To date, di company na di largest holder of oil exploration blocks for Africa.

Im be di founder of Triax airlines wey im starts for 1992, afta dem deregulate airlines for Nigeria.

Di airline wey get base for Enugu Airport get three B727s until dem stop operation for the year 2000.

Wetin we sabi about Arthur Eze and Politics

Arthur Eze don donate plenti moni to di People’s Democratic Party (PDP), e give almost $100 million to support politicians for Anambra State.

Most ogbonge politicians for di state dey cal am “di godfather” as dem dey see am as authority for political matters for southeast Nigeria.

Although Arthur still dey donate to di People’s Democratic Party (PDP), he still supports oda political parties as well

Some pipo bin dey argue say “godfatherism” for Anambra State start wen Arthur Eze sponsor Senator Joy Emordi for 2005, afta dem cancel Emmanuel Anosike’s election.

Dem even tok say na for im sitting room dem form di ‘All Progressive Grand Alliance’ (APGA).

Arthur na Anambra State newsmaker

Latest tori about Prince Arthur Eze na say Govnor of Anambra State, Chief Willie Obiano, don sama one-year suspension on 12 traditional rulers for Anambra wey travel on a trip to Abuja wit di oil magnate to see President Muhammad Buhari.

Tori wey local media dey report na say di chief chop accuse say dem travel wit Eze to report di govnor to di Nigerian president as di govnor never conduct local government elections for di state among oda complaints wey BBC Pidgin no fit confam as at di time of dis tori.

BBC NEWS PIDGIN

Leave A Reply

Your email address will not be published.

This website uses cookies to improve your experience. We'll assume you're ok with this, but you can opt-out if you wish. Accept Read More